published on in Informative Details

Uefa Champions League: FC Copenhagen vs Manchester City, RB Leipzig vs Real Madrid, FC Porto vs Arse

13 February 2024

Di Uefa Champions league Round of 16 matches go start on Tuesday 13 February, 2024.

Di league bin go on a short break afta di Group stage of di competition.

Uefa, wey be di organisers of di league divide di matches for di round of 16 into two.

Di first set go play on 13 and 14 February while di second group go play on 20 and 21 February.

Denmark side FC Copenhagen go face defending champions Manchester City for di first match on Tuesday.

FC Copenhagen vs Manchester City

Ahead of dis match between FC Cophenhagen and Manchester City, di two teams ready for each oda well well dem dey hope to out play each oda.

Di return of striker Erling Haaland to di Manchester city team afta two months don give Manchester City attack more boost.

But oga, Pep Guardiola don tell Erling Haaland to feel more relaxed, make im no worry imsef to score goals.

"Im dey focused on goals, but no be just to score goal," Guardiola tok.

Meanwhile FC Cophenhagen too ready for Manchester City. Dem no be pushovers.

Dem finish second of Group A wit 8 points behind German giants Bayern Munich.

RB Leipzig vs Real Madrid

Anoda match wey pipo eyes go dey on na di clash of two German club, RB Leipzig and Spanish giants, Real Madrid.

From di look of tins dis match na between RB Leipzig wey neva win di cup before and 14 time winners Real Madrid.

So Real Madrid wit dia achievement over di years get beta chance to outplay Leipzig.

Tori be say Jude Bellingham go miss di last-16 first-leg tie sake of sprained ankle.

E get di injury afta e score two goals for Saturday 4-0 La Liga win over Girona.

Carlo Ancelotti side win all dia Group C matches home and away. Madrid averaged over two goals per game for dia routine progression to di last 16.

Di six-game winning run na dia longest for di competition since dia10-match streak of victories between April 2014 and February 2015.

Lazio vs Bayern Munich

SS Lazio and Bayern Munich go happun on Wednesday 14, February 2024 for di Olympic Stadium by 9pm for night.

Di clubs dey meet again afta three years wen dem jam each oda.

Bayern Munich and Lazio don meet only two times and e be like say Thomas Tuchel team stand beta chance to win dis tie.

According to records, Bayern Munich neva lost any round of 16 first leg for di last 11 years. Dem win seven draw four.

For Lazio side, dem bin don lose five of dia last six encounters wit German teams, except dia 3-1 win over Dortmund for di start of dia 2020/21 campaign.

Bayern Munich top dia group wit 18 points, while Lazio lose two matches out of five, dem finish behund Atletico Madrid for Group E wit 10 points.

PSG vs Real Sociedad

France Ligue 1 club Paris Saint Germain and Italian Serie A side Real Sociedad for battle am for din Round of 16 tie.

PSG go play Champions League football for di first time in two months.

PSG qualify for di last 16 afta dem finish second for Group F, dem shock pipo s dem no win any of dia last three group-stage matches.

Paris Saint Germaine dey qualifty for di last 16 for di 12th time in a row and dem go fight hard make dem no remove dem for di third time.

Two seasons ago, na Real Madrid and Bayern Munich remove dem.

For Real Sociedad, di last time dem play for di Champions league na di 2013-2014 Champions League.

Dem return for di first time since di 2003–04 season, but na for playoffs.

Dis match go happun on Wednesday 14 February , 2024 by 9pm for night.

Fixtures for next week

Inter Milan vs Atletico Madrid

PSV Eindhoven vs Borrusia Dortmund

FC Porto vs Arsenal

Napoli vs Barcelona

ncG1vNJzZmivp6x7o67CZ5qopV%2BltqWzyKdmmqqknrCtsdJomrOqnJy9dH%2FWo2%2Bo